Wednesday, May 29, 2024

AS YOU GO TO BED TONIGHT


Take time out to pray
Stand in the gap
Make sure you pray
Because is time for all to pray
Our country no die oooh.

E dey your hand and mine hand
I say things get as e bi
And if we no do something
I pray say make something no do us
Some many plenty things no dey okay.

Because as e dey go like these
Things don fall apart finish
As see finish don even enter the matter
Now the center no fit hold again
As things don fall apart finish for our eyes.

Naija nija make una pray
Make water no go pass garri
Make tortise no run leave us behind
Make watin we no want become our own
Make we no start to dey look for black goat during the day.

Make our land no fit to live inside again
Will need to wake up before water enter our eyes
When we still dey inside water
9ja wakeup na time for prayer bi this
Shine your eyes and see the matter of the nation as e dey go.

No comments:

Post a Comment