Monday, August 24, 2020

HOPE E STILL DEY

To that person wey be say
E dey tire to wait for things to change
To that person wey think say
Tomorrow no sure for em again
Hope e still dey for that person

Even when no body dey again
As every don walker leave you
No family no friends so tail
Everybody don’t leave you
Hope e still dey

To that one wey katakata
Surround you like garri
Wey dey inside water
You look back nobody dey
You look front your eyes no clear to see

Hope e still dey
For that person wey be like say
Him dream no sure to see tomorrow
Even when everybody dey talk say
Tomorrow get belle 
You don lose small hope

You dey look everyday
But you no know where
The next garri go come
Walker walker no get any real sense result
Hope still dey

To you wey think say
Hope don walker leave your house
As you don wet your pillow with water
You don cry so tel one big bucket don full
Hope don come ought from the street
Wey dem dey call hope

No matter watin don happen
Gather liver tie your belt weller
Make sure say the water no carry you go
Stand kagered even wen water come
Remember say darkness go first come before light

No comments:

Post a Comment