Wednesday, August 30, 2023

NO SET GOAL, WEY YOU NO FIT CATCH.


Many people just dey manage life
Dey just dey life upon say
Their mind no sweet them
Yet dey no dey life fine for their eyes
Dey expect so much from life.

As dem dey follow
Other people clock life their life
They want to dey chase
Watin no dey their plan for life
Na this one make dem dey compare their life.

You see ehen life
No need all these ones
Wey dey happen is either
You chose to slow down
And take life easy on yourself
Because if you look back today to yesterday.

You go see say
Many people are not satisfied
With where they are today
But trust me, you can’t just give up now
You just have to keep pushing.

Yes oooh
Dey push even if the punch too much
Dey work even if the distance dey far
no stop to dey work on yourself
Set the goal but set the one wey you fit catch.

No let society pressure you die
Waka at your speed not another person speed
Make sure you dey awake always
Ready to grab all the opportunity wey come your way
Make sure say you set goal wey you fit catch.

Remember say
E dey okay to cry
E dey okay to get tired
E dey okay to won run but no try ‘em
You no watin no dey okay, na to give up no dey okay.

No comments:

Post a Comment