Wednesday, November 22, 2023

CHRISTMAS FOR WHO?


For that pikini wey no nothing 
About Christmas as nothing 
Like new cloth for him body 
Nothing like Cinderia shoe for her leg
Christmas for who?

For that person papa
Wey don try to make sure
He carry if not Christmas chicken go house
Come follow rice to use julifocate for Christmas
Abeg this Christmas for who?

Still dey sleep under bridge 
Wey no get the house to return to
After everyday work as night dey come closer
Wey bi say na bus stop be their room
Christmas for who?

For that one wey no get 
Single kobo for pocket 
To use flenjor during Christmas 
All becos nor bi laziness but pepper no red
Christmas for who?

For de one wey no get nothing to show
For Christmas dey just dey look
Dey wait for God knows when
Wey bi like say things no dey work out wellah
Christmas for who?

No comments:

Post a Comment