Tuesday, April 16, 2013

THIS KIND FRIEND!


I don they walker for everywhere
I don go so many places
I don meet so many friends
Online and offline here and that place
But you see this kind of friend

I never ever see em oh
Him be friend wey no dey fall hand at all
When you go meet em self Him go raise you
Him go tarsih you something, Him no go farish you at all
Because Him don talk em tel, tel eah

E dey keep Him words
Because for inside Him Holy book him don talk there say
All Him promises na true for sure e dey real
Say he dey sure Him no dey do mago, mago
No bi player but Him na sure banker

Just try em first e go be like dream for your eyes
With your mouth go open wide wow so na true dem talk
Start there na more than true He dey sure
That’s why I call em Jevoah sharp, sharp
Him no dey waste time…this kind God dey wellar for real

You no watin I dey call em
Jehovah a-fisi…wey dey do more watin we ask em
Jehovah sharp, sharp…em network no dey fail at all
Jehovah full ground…em dey everywhere you go
Jehovah kerosene…e dey work and walker 24/7
Jehovah my paldi…em bi that kind friend wey no dey fake up
Jehovah with me…him no dey far at all e dey e no dey travel

To you watin Him be?
Sha you know em like your body
Abi you just they play fast game with em
See you know no watin you dey miss at all, at all
Because I don try em, e dey pass watin we think say Him be
I dey tell you this kind God He no dey any where at all

Watin self! see your life
Na that tin way you dey worhip for the backyard
Or inside of your house wey no dey talk, eat, breath even walker self
Na you dey call your god see no bi the way at all…
Because he no fit save at all, at all try this kind friend (God) today

Watin self see your life
Na that tin way you dey worhip for the backyard
Or inside your house wey no dey talk, eat, breath even walker
Na you dey call your god see no bi the way at all…
Because he no fit save at all
Text Box: 12th April, 2013. Friday
8:27am © 2013 
www.motitalk.blogspot.com
Godleadlittle@yahoo.com
 

1 comment:

  1. Hello,
    Love your blog! I’m part of a team of writers on Nigerian Writers’ Choice and we’re looking for good works from Nigerian writers online to review, share and add to our list of prolific bloggers.
    If you are interested, you could send a sample of your work to admin@blogemcity.com
    Thanks!

    ReplyDelete