Problem
yanful yanful for everywhere
Your
life no get meaning again
And
you won end everything
You
no fit pray again
Your
faith to waka far
Na
your mouth don close like super glue
Everything
na bad news as e dey fall apart
Your
life don fall apart before your own eyes
And
yet you still dey carry the face of pity up and down
Prayer
don go far from your mouth
Na
because you fail to believe
Your
problem don become like army
Wey
don conquer your faith
Na
your fear don eat your confident up
See
as you burier your face inside shame
See
as you don turn to watin dem they use laugh
You
con dey ask yourself where God dey
River
don cover you ocean wen drink you up
The
whala of life don finish the boat of your life
Even
self you no sure of winning anymore as so, so defeat dey around you
The
problem don plenty sotel you don forget
Wetin
God talk inside Him word… Him promise
You
don forget say e get one guy wey dey inside
Bible
Him
name na Elijah see as dat guy pray make rain no pour
And
that prayer come to pass so watin be your own
You
will be a new creature
While
you no fit wake up waka from that pity palce
And
go face Baba God in prayer open your mouth
Make
that prayer come from inside your heart
Tell
about the situation because na Him get power to finish ‘em
See
my sister…my brother
Watin
be that mountain wey you dey face now
Watin
be that thing wey dey make heart fly
My
brother…my sister the answer dey near you there
Y
all this tin dey happin because say you no believe
No comments:
Post a Comment