Thursday, March 24, 2022

9JA DON FAIL HIM GUY



To that person wey dey road
Wey hustle to send himself to school
Wey dem no give 'em silver spoon
When them born 'em
Wey no get a ready made system
To build on wey build from the scratch

Him no fit serve 9ja
With all him strength again
Talkless about using muscle
Because him don complain
So teil mouth don dry
As salver finish for tongue

To the one wey the man
Wey dey fight for president lied to
Say dem go give better life
Once they vote em into power
E reach Aso Rock e start to
Dey behave as if na him be God

To that person wey
No get house to return after the days hustle
Wey still go hustle space for BRT bus stop
Just to crash for the night
As mosquito with chilled cold bi him sleeping mate

9ja you don fail your guy
Your guy wey dey loyal to you
Wey don serve you with
All him strength and everything wey e get
Ha you really fail your guy

Sha na for security
You no fit secure him life
As people wey suppose to secure your guy
Use stray bullet kill 'em
Ha 9ja you don fail your guy

See as him life don turn out to be
E go school come out with first class
Brain dey hot like fire
Haba see go see 'em now walker walker
Don finish him head him shoe don chop

9ja you no try at all
You fuck your guy up wella
Wey trust you carry you for chest join
Na only for election you dey remember your guy
Just to use 'em cos cater cater 9ja hmmm
E well ohhhh even inside the well.

No comments:

Post a Comment