Wednesday, May 25, 2022

SHINE YOUR EYES AND GET SENSE




Election don show
Make sure say you dey read
‘cos na who prepare
Na him go reach where e dey go
Make sure you say you shine your eyes

Because street now don full
You go see different kinds of stuff
Those who go walker come meet you
Say dem get better plan
Shine your eyes election dey around

Na now you go see money bag politicians
And their party people they walker
Morning, afternoon and night
Looking for watin no lose
My paddy shine your eyes

Because e bi like say
Dey want to act another movie again
Dey want to dance galegale na the new dance again
Dey want to call another calling again
Shine your eyes

Open your eyes wild enough
So soap no go enter your eyes
While you dey inside water
Wey you for use clean your eyes
Shine your eyes

No take ‘cos of watin
You go chop now and sell your future
Because e better you take stand now
And shine your eyes wella
Cos election don dey around the corner

Shien your eyes and get sense
Na only mumu dem they play two times
And this time mumu don do
Our eyes don tear and e don open wild so my country people shine your eyes and get sense

No comments:

Post a Comment