Tuesday, August 2, 2022

NA GRACE CARRY ME COME NOR BI OKADA MAN II


Out of the abundant of the heart
The mouth go talk life na relay
But we no fit experience delay
Because overtaking is allowed
So na matter how traffic
 
Won take hold holdup
We no fit go slow
God too dey show us excess love
You are a capable God that’s why
We no fit put in front of our melody
 
So my friend walk by faith
No go walker by sight
Baba for you to generate power
You no need to become kainjidam
Because no bi Nepa dey give You sunlight
 
 So no matter the situation
Won take bi if e like make e turn highness
But our faith will never stagger
For you to become bread winner
You no need to turn oven
 
How you take dey supply
Our daily bread yet You no get bakery
Way maker Julius Berger dey learn work
Where You dey
Na grace carry me come nor bi okada man
 
Promise keeper we no rely on government
For minimum wage because you never change
With You there is no retreat nor no surrender
You no dey sleep…You no dey slumber
For our matter you no fit pipe low
 
Because You no bi plumber
Will live above the systems of this world
Dem no fit tell us stay here because
Jesus is taking care of us pass pikini
Wey dey for day-care
 
God You still be who you be
Nobody reach you some trust
In horses some trust in chariots
Some trust in the government and economy
Of their country but will put our trust in the name of our Lord

No comments:

Post a Comment