Tuesday, September 13, 2022

GO TELL MAMA SAY


Say e get as things be
Everywhere no bi the same
Street no dey smile like before
Water self no dey inside drum again
Small money no fit buy plenty things

Motor don leave our economy
So long we don dey find watin no loose
As government dey play us
After one administration fine another come
Still on still on the matter we no move forward

Tomorrow no pure again
As tomorrow dey far from today
Even today self to see tomorrow
Na on God as na Him sure pass for now
Go tell mama

Say pikin dem no dey house again
As house na don turn to where you
Fit find pikin during school time
Go tell mama say money dey pursue
Few commodity for market there

Our money don miss road
As dollar don use beating
Beat 'em finish so tall
Our money no get mouth again
Where dollar day go tell mama

Say our mumu don do
We don hear so many fake promise
Dey don use politrick trick us
Corni man dem don corny us die
Go tell mama say our suffer don too much.

No comments:

Post a Comment