Saturday, November 12, 2022

REGARDLESS


Life dey hard
Dollar dey rise everyday
Five k no dey buy much again
But regardless

Make sure you hold body
Make sure say no body pressure you
Make sure say you dey in charge always
Make sure you stay strong fit like fit farm
Regardless

Of how today bi
Get liver with strong heart
Be always up don't let
The issues of life weigh you down
Regardless

Even inflation dey pursue
You up and down
Money wey dey your hand
No fit buy something wey tangible
Regardless

If tomorrow no sure
Get belief say go make sense
One day if you no give up
Because na only who reach finishline dey win
Regardless

No take your life
Because life go sweet again
And you go smile again e sure die
Abeg no cry no think 'em
Regardless sometin wey hot go cold again.

No comments:

Post a Comment