Saturday, April 17, 2021

ALTHOUGH


Although water no dey inside coconut
And e be like say tomorrow don Waka leave you.
Although katakata bust for everywhere
So fear dey parade for everything.
Although sun refuse to show him face
E Kon be like say tomorrow go dark.

Although e be like say,
Time no dey again, everything dey fail,
Anything you touch be like say e too dey far.
Although e be like say rain won fall
And one drop of water no even comot from heaven.
E con be like say God don forget his own

Although your heart dey heavy
And e wan jump comot for your chest.
Your head don full so tey you don dey think upside down.
Although nothing dey work

Although your friends don waka leave you,
Dey don give you all the bad names wey full this life.
Dey call you vegetable, property wey no get value.
E con be like say you wan kuku take your life with your hand.
Although your leg don dey fear to carry your body

Although things dey happen,
Money no dey for hand talkless for pocket,
Your landlord dey flash you red card
Make you fade ccomot and nothing dey show.
You don carry water finish for your eyes

No matter wetin happen,
Use hand hold your chest.
Dry your eyes,oh! Abeg no cry again.
For this life baba God don talk say we go make am,
Even when sorrow go come like storm, 
No worry, peace like water go still flow come.

E go better.
E go end for happiness.
God no dey lie.
Him promise dey sure
If anything happen,God no dey leave him own
No matter wetin happen
Sun go shine again.

1 comment: