Saturday, April 17, 2021

NO MATTER WATIN HAPPEN


Even though everything no dey alright
Even though watin you dey expect no show
And be like say katakata don burst for your head
Bad belle just dey follow you everywhere you waker go
Even though

Tomorrow be like say e no get belle
All watin you plan no amount to anything
You con be like say na only you waka come this life
As you dey look others they waka with their partner
Only you just dey waka your own

Even though the person wey get where you dey live
They show you some kind green card
Talk for say you no pay your rent
And everything don turn to things fall apart
For your  korokoro eye all your plan dey fall like water inside garri
Even though

Garri no dey for house, soup don waka go leave
Money far from your pocket you no fit pay for anything
Pikin no dey school say because school fees you no pay you tire for life
Tomorrow wey near before you don waka live you teltel
Hungry become your close paddy

Life tire you tomorrow don go transfer 
You dey fear even self to live to see tomorrow while you still dey today
Bad belle just dey follow you up and down
Heavy knock wey you get from frustration
Dey kill you inside small, small one day you go kick bucket

Even though you don marry teltel
And everybody dey expect pikin
And pikin no show at all you cry your eyes out
Water finish for your eyes
Even though mother in law won pursue come hot for your husband house

Abeg no cry dry your eyes
For this life papa God don talk say we go maker
That house you pay the rent build your own
Dem that your pikin go school get job come live good life
That pikini you go get em bokunbokun
Even though katakata dey fly everywhere just get faith

No comments:

Post a Comment